Wife of Governor Umo Eno of Akwa Ibom State, Patience Umo Eno don die, di state goment confam.
Na Ini Ememobong, di Commissioner for Information for di state tok am on Friday.
“Na wit heavy heart we announce di passing of di Wife of di Executive Governor of Akwa Ibom State, Her Excellency, Pastor Mrs Patience Umo Eno,” Ememobong tok for di statement.
Di statement say di wife of di govnor bin dey sick – e no tok di kain sickness wey worry her.
E add say di govnor wife Patience Umo Eno die for hospital on Thursday “in di presence of her family”.
“Di family submit to di will of di Almighty and ask for di prayers and support of kind-hearted individuals during dis difficult time.”
Ememobong say di family go provide more informate wen e dey necessary.
Di last time Patience Umo Eno dey active for social media na on 24 September, 2024 wen she follow mark di 37th year anniversary of Akwa Ibom state.
President Bola Tinubu send im condolence to Governor Umo Eno of Akwa Ibom state sake of di death of im wife.
E condole wit di govnor, im family and Akwa Ibom pipo on behalf of di Federal goment.
“President Tinubu acknowledge say thru her ‘Golden Initiative for All,’ she demonstrate her passion for serving di pipo people and residents of Akwa Ibom state with love, honesty, and dedication, leaving a positive impact wey go kontinu to inspire future generations,” Special Adviser to di President on Information and Strategy, Bayo Onanuga tok for statement.
Patience Umo Eno profile
Di late Patience Umo Eno na di wife of Akwa Ibom state govnor.
According to one of her Facebook post, dem marry 37 years ago.
According to local media The Nation, she from Ikot Akpa Ekop, wey be one of di communities for Ikpa Ibom.
Na one of di biggest clans for Mkpat Enin. Di community get plenti oil and dem dey farm too.
She get six children and nine grandchildren.
She setup her foundation Golden Initiative For All (GIFA) to do charity and humanitarian work.
Wit di project she bin provide water for communities, campaign for support for breastfeeding mothers,
She also dey provide accommodation, food, and education to improve pipo lives and di livelihoods of poor and vulnerable pipo.