Home » All five suspects of deadly Offa robbery dey guilty – Court
Africa Global News News

All five suspects of deadly Offa robbery dey guilty – Court

Court for Kwara state, Northcentral Nigeria, don find all five members of di Offa robbery attack guilty.

Justice Haleema Salman of di Kwara State High court, Ilorin, say ‘No evidence from di defendants show say dem get any license to carry arms.

All di pipo wey dem accuse dey guilty of illegal possession of firearms.

Di Court also find dem guilty of conspiracy to commit armed robbery and armed robbery.

Court also find dem guilty of conspiracy to commit culpable homicide and culpable homicide, wey dey punishable by death.

According to local media, di prosecution counsel tok say COVID-19 period and national assignment wey di judge bin dey do na wetin delay di process.

Di representative of di defence counsel, say dem go appeal di judgement.

Court bin reserve reserved judgement for di case for July.

More dan 30 pipo die for di robbery including policemen. Di case bin dey go on since 2018

Nigeria Police bin confam di arrest of two suspects from di robbery attack wey happun for Offa town, Kwara State Northcentral Nigeria wia 17 pipo die.

Former govnor Abdulfatah Ahmed bin put money as reward for anybodi wey get information wey fit help authorities catch di criminals.

For inside police official X account, dem post more dan 10 tweets on dis mata, wia dem say di two suspects confess say na dem be di gang leaders and say na for Kwara State – wia di robbery attack happun – na dia dem catch di two of dem.

Source

Translate